Nigerian Afrobeat musician, Falz, don tok say im no get any plan to remove im 'This is Nigeria' video.
Muslim Rights Concern (MURIC) on Tuesday give Falz seven days to clean di music video or dem go cari am go court.
In fact, di tin don catch fire for Nigeria social media as some pipo tok say di MURIC warning no make sense and odas support di group.
Falz manager, Femisoro Ajayi, tell BBC say wetin dey happen na pipo wey dey try "shoot di messenger".
Since May 25 wen Falz release di video, e don get moredan 4.2 million views for YouTube.
Abeg make una follow the llinks wey dey under for the full tory!
https://www.bbc.com/pidgin/tori-44380344
Be first to comment